Rochas Okorocha arrested? Police for Imo state tok wetin happun and why dem invite di senator
21 February 2021
Wia dis foto come from, Other
Police tok-tok pesin for Imo state command Ikeokwu Orlando don confam to BBC Pidgin say Senator Rochas, di former govnor of Imo State dey dia hand afta im break into one property.
Okorocha, wey now dey represent Imo West at the Senate, na di governor of di state between 2011 and 2019.
Dis na as tori bin break say police arrest di senator for Owerri.
According to Orlando, di state goment bin seal di premises of di Royal Spring Palms apartment, but Okorocha bin go forcefully break di place.