vimarsana.com

டி தேசிய சங்கம் ஆஃப் குடியிருப்பாளர் மருத்துவர்கள் News Today : Breaking News, Live Updates & Top Stories | Vimarsana

ASUP strike update: Polytechnic lecturers, judicial and doctors strike and how di action dey worry Nigeria

ASUP strike update: Polytechnic lecturers, judicial and doctors strike and how di action dey worry Nigeria 3 hours wey don pass Activities for most courts across Nigeria dey paralysed as dem no open for business as usual sake of di indefinite nationwide strike by di Judiciary Staff Union of Nigeria wey begin on Tuesday, 6April, 2021. On di second day of di action, courts gates remain under lock and key as union staff mount di gate and prevent anybody to enta into di court premises. One resident of Kano, Ayuba Sani telll BBC Pidgin say e travel all di way from Garun Mallam local goment wey be about 50km go Kano city for north west of di kontri to go swear affidavit only to find out say dem dey on strike.

Muhammadu Buhari London travel: Nigerians protest against president Buhari medical trip to UK and what you need to know

Muhammadu Buhari London travel: Nigerians protest against president Buhari medical trip to UK and what you need to know 2 hours wey don pass Some of di Nigerians wey dey live for London don stage back-to-back protest for Abuja house against Nigeria President Muhammadu Buhari trip to di UK for medical check up. Di President bin comot Nigeria on Tuesday, 30, March 2021 on a two weeks medical checkup. On Wednesday, some Nigerians in Diaspora - wey Reno Omokri, former presidential aide lead, carry protest go di UK, London residence of di president. Since den, daily protests to ask Buhari to return to Nigeria don happun.

Resident doctors strike in Nigeria: We want implementation no be MoU - Resident Doctors tell Nigeria goment

Resident doctors strike in Nigeria: We want implementation no be MoU - Resident Doctors tell Nigeria goment 1 April 2021 National Association of Resident Doctors (NARD) say Nobody don reach agreement with Federal Goment on top di nationwide strike of di association wey dey go on. Di Federal Government bin say dem don avert di major nationwide strike as dem sign Memorandum of Action (MOA) with di National Association of Resident Doctors. Oga Chris Ngige, Minister of Labour and Employment, tell tori pipo after im meeting with NARD on Wednesday 31 March for Abuja say di discussion with di resident Doctors dey fruitful and say dem go implement all di things wey dem agree.

© 2025 Vimarsana

vimarsana © 2020. All Rights Reserved.