List of winners in Headies 2020 award, Wizkid, Fireboy win, Burnaboy, Naira Marley lose and oda tins wey happun for di 14th Edition wey happun for 2021
Headies award 2021 winners: Wizkid, Fireboy win, Burnaboy, Naira Marley lose and oda tins wey happun for di 14th Edition to reward 2020 performance 22 February 2021 Wia dis foto come from, Other Di 14th edition of di Nigerian Awards Music Show, The Headies don come and go but wetin happun during di show still dey make headlines. From di artistes wey win big, to di ones wey no collect any award and even di way di show go down, see di highlights from di 14th edition of di show. Di 14th Edition of di Headies happun even as coronavirus still be big issue around di world.