Cross Over Night: We no hear about any end of year restrictions - CAN
Cross Over Night: We no hear about any cross over service restrictions - CAN 29 December 2020 Wia dis foto come from, AFP One Nigerian religious joinbodi, di Christian Association of Nigeria, CAN don announce say dem no hear about any restrictions wey federal goment put for churches say make dem no hold any cross over services for New Year eve. Di tok-tok pesin to CAN Presido, Pastor Bayo Adedeji bin tell BBC Yoruba say before now dem tell dia member churches make dem follow wetin state goments dey order. However, churches go fit hold dia cross over services earlier than usually so dat dia me...