Geidam attack and oda ones wey happun for Nigeria in 72 hours
Geidam attack and oda ones wey happun for Nigeria in 72 hours 26 April 2021, 10:58 WAT New Informate 14 minutes wey don pass Nigeria experience several attacks in di last three days wey make many dey wonder whether di kontri's fight against insecurity dey go anywhere. From several attacks in di northeast to kidnappings for north-western Kaduna state to bandits attacks for north central state of Niger and gunmen attacks for di south. Here na some of di high profile attacks wey happun. Geidam attack Dis na di most popular and most high profile because say gunmen wey many say na Boko Haram take ...