Akungba accident: Traffic collusion of Dangote trailer truck for Adekunle Ajasin University Ondo kill pipo
24 January 2021
Wetin we call dis foto,
Students dey para sake of di accident
Adekunle Ajasin Univeristy, Akungba Akoko for Ondo State don close down afta protest by students on Sunday, 24th January, 2021 sake of traffic collusion of Dangote trailer truck wey kill pipo.
Acting Vice Chancellor of di University, Prof Olugbenga Ige direct say make di University close with immediate effect until further notice.All students based on dis mata dey advised to leave alias vacate di campus latest by 6pm today, Sunday 24th January, 2021.