NIN SIM Registration: Important documents you go need your National Identification Number 18 December 2020 Wia dis foto come from, National Identity Management Commission Di National Identification Number (NIN) na wetin Nigeria goment dey use establish di identity of every Nigerian. All citizens and legal residents for Nigeria, from age zero (birth) and above dey eligible to enrol for dia NINs. E dey important for every Nigerian to get am sake of say na im di NIN dem dey use tie togeda all di records about individuals for di kontri. Di include di demographic data, fingerprints, head-to-shoulder facial picture, oda biometric data and digital signature for di National Identity Database wey make am easy to confam and verify pesin identity.