Sasha Johnson: Police investigation reveal who shoot Black lives matter activist Sasha Johnson in UK 25 May 2021 Wetin we call dis foto, Sasha Johnson is a prominent Black Lives Matter activist Met police don reveal say na one group of four black men shoot prominent Black Lives Matter activist for one party for south London. Sasha Johnson dey critically ill for hospital afta dem shoot her for head for one property for Peckham on Sunday. Met Commander Alison Heydari say di men bin "enter di garden of di property and discharge a firearm". Ms Johnson party say she bin previously receive death threats but police say "nothing to suggest" say na "targeted attack".