How Benue boys dey operate, gang rape girls for Obi local goment
How some men for Benue state dey rape girls at gunpoint, threaten to kill dem if dem tok 16 February 2021 (File image) Benue state-north central Nigeria don begin look for gang of four boys wey dey rape girls and do video of di rape. Dis recent search for dis gang dey come afta dem rape and video one 16-year old girl for Obi local goment area of Benue state-north central Nigeria. Di gang of four wit dia nickname( John, J boy, Of law, and Maleky) don dey terrorise women for di area and di rape -rape small small girls for di village.