Kasoa Murder: Police arrest witch Ghana doctor wey direct two teenagers to kill virgin for ritual money
Kasoa Murder: Ghana police arrest witch doctor wey direct two teenagers to kill virgin for ritual money 2 hours wey don pass Wia dis foto come from, Seth Kofi Yeboah Ghana Police arrest witch doctor wey encourage teenagers to bring am body of a virgin, plus Ghc5000, so say den go become rich. Reports be say dem arrest am for Amanase, Eastern Region where she dey hide. De two suspects Felix Nyarko, 16, den Nicholas Kiki, 18, talk police after dema arrest say, one spiritualist dem see for TV top direct dem to bring virgin dead body den Ghc5000 for de money rituals.