'Onion traders cut supply from northern Nigeria' to southeast after Mbaise attack 3 June 2021, 13:45 WAT New Informate 28 minutes wey don pass Onion traders up north for Nigeria don suspend supply of di vegetable to di southeast region. Leader of di association of onion producers and marketers say dem take di decision due to insecurity. Aliyu Isah say di supply cut go dey until further notice. "We no go supply onions to South East until security dey even if na 10 years." On May 30, 2021, jaguda pipo hijack and tiff two trucks wey dem load with onion for Mbaise local goment area of Imo state.