Happy Easter message: 'He is risen' - Pope Francis ask pipo not to 'lose hope' sake of coronavirus - See oda tins e tok
Happy Easter message: 'He is risen' - Pope Francis ask pipo not to 'lose hope' sake of coronavirus - See oda tins e tok 4 April 2021 Wia dis foto come from, Getty Images Di Catholic Pope Francis don give im ninth annual Urbi et Orbi alias Easter Message for di St Peter's Basilica. For di Saturday Easter vigil, di Pope bin focus im message for wia Jesus go afta im bin rise, Galilee and wetin dat one mean for believers. E admonish pipo say "for dis dark months of pandemic, make we listen to di Risen Lord as im call us to start afresh and no loose hope."