Adesua Etomi Wellington, Banky W baby Zaiah: Baby Zaiah meaning plus Wellington's interesting gist 22 February 2021 Wia dis foto come from, Instagram/@adesuaetomi Adesua Etomi Wellington and Bankole Wellington AKA Banky W baby Zaiah arrival dey sweet belle of many Nigerians. Di Nollywood actress and her husband wey be Nigerian afrobeat singer finally announce for dia social media handle say she born baby boy, four weeks afta dem born di pikin and fans of di couple no fit hide dia joy. Hundreds of thousands 'congratulations, well wishes and love' don dey pour in from different corner to Nollywood actress Adesua Etomi sake of di birth of her son, Zaiah.