Enoh T. Ebong: US President Joe Biden appoint Nigerian-American as acting diector of USTDA
3 February 2021
Wia dis foto come from, Enoh Ebong
America President Joe Biden on Tuesday appoint Nigerian-American Enoh T. Ebong as di Acting Director of di U.S. Trade and Development Agency.
Madam Enoh go be di fourth pesin wit Nigerian roots, oga Biden go appoint into key positions for di kontri since dem elect am as President for November 2020.
Di U.S. Trade and Development Agency dey perform many roles among which na to link US businesses to export opportunities as dem dey fund and build partnership wey go lead to di development of sustainable infrastructure and foster economic growth for partner kontris.