Biden inauguration: Destiny Burna Boy song make list - See di songs for di playlist 20 January 2021 Wia dis foto come from, Getty Images Nigerian artist, Burna boy don feature for di official playlist for President-Elect Joe Biden's inauguration. Burna Boy song wey dey titled Destiny go feature alongside oda big international artists' songs. Di 46-song playlist wey dem gada go reflect di diversity for di US, na so Biden inauguration team tok for statement. "Dis songs and artists reflect di relentless spirit and rich diversity of America. Na dem be di score to a new chapter and gol help bring pipo together as di Biden-Harris Administration begin im important work to unite our kontri," di statement tok.